SHOCKER: President Trump give reasons why Obama cause Syria Chemical Attack

President Donald Trump say na because of the way Obama dey do as president, na make Syria done day use chemical weapon. He say, if Obama take dem seriously, things for no bad reach how dem be today.

Chemical weapons na also waytn oyinbo dey call “Weapons of Mass Distruction” (WMD) which mean say, na dat kind of weapon wai day kill plenty people at once.

Dozens of people die on Tuesday (4th April 2017) wen dem bomb one hospital while many injured civilians dey get treatment from chemical attack. Human Right Activists tok say de attack na one of the badest since fighting don start for dat country for six-year now.

Life for Syria na suffer-head. On top of all the killing and flying bullet, dis bad attack don join put. Among the people when suffer from the chemical attack, na women, children and innocent people wen no join mouth for the fight matter.

Trump blast Obama say for 2012, Obama say US no go gree for President Assad of Syria to use chemical weapons, Obama say if he dear, US go enter him country and treat him fork up.

Later, Assad still use chemical weapon and Obama no do am anything, Obama just yab am but him no send his military as promised, however many aproko dey say na Obama give the rebels weapons and that same rebels na ISIS who also dash Boko Haram weapons. 

 
The thing wai no kon make sence na the fact say Trump oppose Obama that year wen he dey call am mumu on Twitter if he attack Syria. For 2013 Trump tweeted

"AGAIN, TO OUR VERY FOOLISH LEADER, DO NOT ATTACK SYRIA — IF YOU DO MANY VERY BAD THINGS WILL HAPPEN & FROM THAT FIGHT THE U.S. GETS NOTHING!"

Trump don already make am clear say he no day interested in overthrowing Assad even though the man get the type of weapon wen make George W. Bush attack Iraq. Assad na also friend of Russia so since Russia’s Putin and Trump na like 5 and 6, he no go join mouth put for that fight. This na the same fight way done make millions of refugees leave Syria enter everywhere for the Middle East to Europe, to Australia and America.





Comments