Policeman Kill Okada Rider Over N50


One policeman wai dey petch ‎along Aliade-Awajir road for Benue State, vex shot okada man just because of fifty naira rocha.

The okada rider who's name na Friday go 'buy market‎' when he put mouth for matter wai no concern am. The late Okada rider see the police dey argue with another okada rider over N50 rocha and con try to settle dem na the police vex shot am exactly for him forehead. The police man mean am for him life for him to target the forehead. Poor Friday drop dead on the spot. 

As Idoma Voice Newspaper report; This yeye behaviour of the police man provoke youth for the area as them start to dey protest well well. Some say dey must burn that police station because, how N50 con worth human life?

When dem ask Moses Yamu who be the Police Public Relation Officer about the matter, he talk say him no know anything about the matter so how him fit talk? He say official report about the matter never reach their office, say him go "find out and get back to you".‎ That na another way of saying, make una leave me alone, waiten don happen don happen.

Comments