Mark Zuckerberg return Nigeria for presidential homage


After he don leave us almost 2 days ago for Kenya. Mark Zuckerberg kon realise say him never greet our oga at the top. ‎Na he tell pilot to revise come Abuja where he meet President Mohammadu Buhari and the Vice President.

Once ago, the Facebook CEO wear suit again as if na Pope he dey visit and joy just dey catch everybody wai dey dir as dem dey smile from ear to ear.

He show our president the small air-craft (drown)‎ wai go bring cheap Internet for places where people no even get signal for internet... But just yesterday, small tragedy happen wen the satellite mission for this project fail, but Mr Zuckerberg get Plan B like any correct whiteman.


Related Post:

Mark Zuckerberg Don Land Nigeria

Mark Zuckerberg press pounded-yam for 'mama put'

Cha! Mark Zuckerberg wear suit visit Pope

Comments